Bomb blow,
Country people wound,
Country people die,
House dem damage,
Property sef spoil.

Country man
Wey dey advise Presido
For security matter
Come yan say
Na because of election
Wey dey come
Na im make bomb dey blow.

Presido
Come yan say
Na lie adviser talk,
Opposition come hala say
Make Presido sack adviser.

As dem dey talk talk,
Bomb still dey blow,
Country people still dey wound,
Country people still dey die,
House dem still dey damage,
Property still dey spoil,
Which kin yawa be dis?

Chidi Anthony Opara

http://www.poemhunter.com/poem/which-kin-yawa-be-dis-poem-in-nigerian-pidgin-english/