It is dark
The ghetto, even the big city
self wey get tall tall buildings
all of dem dark.
No light
Except for God light
Wey dey shine tru n true.
Everywhere dey boring
Especially wen everybody
Don commot go hustle
For night,
dem go on I better
pass my neighbor wey the noise
and the smoke no good for body.
Bad road,
Fit commot woman belle
sote another person compound
don turn major route.
Finish big school
no job, the one wey dey na
transport shop the salary finish.
Okada
wey person take dey
maintain, ogas for top done banam,
turning sand inside garri.
Good water
No dey to drink, the wan wey dey,
we go Waka tire and if we dey come
back, dust and dirty Don fullam.
Even the borehole wey ogas dem
build, hungry boys don corner am
Boko haram
No dey allow me sleep like pikin
again, I don turn fish wey dey
use one eye sleep weda day or night

Enebeli Prada

http://www.poemhunter.com/poem/african-child-lamentation/